Simon Ekpa lawyer react to extradition report of IPOB promoter to Nigeria

3 hours wey don pass
Lawyer to Simon Ekpa wey be promoter of di proscribed group Indigenous Pipo of Biafra (Ipob) wey land for Finland prison don give response ontop reports say dem go extradite im client to Nigeria.
Dis na afta tori wey dey fly for Nigeria local media say court for Finland don set date for Simon EKpa to come Nigeria sake of charges against am.
Meanwhile, wen dem gbab Ekpa for Finland, di Chief of Defence Staff for Nigeria say dat fit be di korrect steps to take extradite am come Nigeria to ‘face justice’.
For November 2024, local tori pipo for Finland report say di District Court of Päijät-Häme send Ekpa go prison and since dat time, di Lahti municipal politician don dey chill behind bars.
As Ekpa still dey prison Nigeria goment list am among di 17 individuals wey dey di Nigeria Sanction List and freeze dia accounts sake of alleged activities wey surround issues of terrorism.
Howeva, Ekpa wey be Nigerian man from di Southeast region of di kontri also get Finland passport wey make am a citizen of di European Union.
But e no clear weda all plans don conclude ontop di matter to extradite Ekpa come Nigeria as di lawyer tell BBC News Pidgin last week say na till June 2025 e go appear for court.